1
Efesians 1:18-21
Holy Bible Nigerian Pidgin English
pcm
Una eye don open to undastand di grace wey God koll una kom enter and una don si how di blessing wey E promise en pipol, plenty rish. Una don si how en pawa big rish, bikos una bilive am. Dis na di pawa wey dey do big-big tins for us. E show dis pawa thru Christ, wen E raiz am from deat, kon make am sidan for en rite hand for heaven; di place wey far well-well, wey high pass where wiked pipol dey rule; wey strong pass evry pawa wey dey dis world; big pass evry name wey dey for dis world and di ones wey dey kom.
对照
探索 Efesians 1:18-21
2
Efesians 1:4-5
Before God kreate di world, E choose us thru Christ bikos E love us, so dat for en front, wi nor go get any fault and wi go dey holy. Before, God don already decide thru Jesus Christ sey, wi go bi en shidren, bikos na so E wont am.
探索 Efesians 1:4-5
3
Efesians 1:7
Na thru Christ blood wi take get salvashon and na dis blood make God dey forgive us awa sins, bikos en grace big well-well.
探索 Efesians 1:7
4
Efesians 1:3
I bless God wey bi awa Oga God Jesus Christ Papa; wey don bless us with difren spiritual blessing from heaven, bikos of Christ.
探索 Efesians 1:3
主页
圣经
计划
视频