But Pita tell am, “Ananias, why yu allow Satan enter yor heart and yu kon dey lie give di Holy Spirit? Why yu keep some for di money wey una sell di land, for unasef? Before una sell di land, nor bi una own propaty? Naw wen una sell am finish, di money nor still bi una own to spend as una like? Wetin make una get dis kind mind? Dis lie wey yu tok so, nor bi pesin yu do am to, but na God!”
Wen Ananias hear di word wey Pita tok, e fall for groun at wons kon die. Dis tin make fear katch evribody wey hear wetin happen.