So my pipol, if God fit give doz Gentile pipol di same gift wey E give us afta wi bilive Jesus Christ, who I bi to stop God?” Wen dem hear wetin Pita tok, dem nor argue with am again, so dem kon start to praiz God. Den dem sey, “Naim bi sey God don give Gentile pipol di shance to take turn from sin kom meet am, so dat dem go get di life wey nor dey end.”