1
1 Korintians 6:19-20
Holy Bible Nigerian Pidgin English
pcm
Abi una nor know sey una body na di temple wey di Holy Spirit dey stay? So, nor bi una get unasef. God don pay betta prize for una, so make una honor am with una body.
对照
探索 1 Korintians 6:19-20
2
1 Korintians 6:9-10
Una nor know sey wiked pipol nor go enter God kingdom? So make una nor fool unasef! Pipol wey dey sleep with who dem nor marry; doz wey dey serve juju; men wey dey sleep with oda men; tif; long-trot; drunkard; doz wey dey curse pipol and doz wey dey play wayo; non of dem go enter God kingdom.
探索 1 Korintians 6:9-10
3
1 Korintians 6:18
Make una nor live ashawo life. Evry oda sin wey man dey kommit na for outside en body, but di pesin wey dey do ashawo, dey sin against en own body.
探索 1 Korintians 6:18
4
1 Korintians 6:12
Some among una sey, “Wi fit do anytin wey wi wont.” But I dey tell una naw sey, nor bi evritin dey good for us. So I nor go gri make anytin kontrol mi.
探索 1 Korintians 6:12
5
1 Korintians 6:14
God go raiz us from deat with di same pawa wey E use take raiz Jesus.
探索 1 Korintians 6:14
主页
圣经
计划
视频