Mark Introdushon

Introdushon
Mark (en full name na John Mark), na Barnabas kousin (Kolossians 4:10). E work with Pita (one of Jesus disciple) and en mama house bi di place where bilivers dey meet for Jerusalem, naim rite di book. E rite am to di bilivers wey dey suffer persecushon from di govment for Rome (8:34-38; 13:9-13). Mark aim na to assure di bilivers sey Jesus Christ naim bi di true Savior, wey God send kon save not only Israel pipol, but Gentile pipol too. One Roman soja wey dey where dem dey kill Jesus konfess, “True-true dis man na God pikin!” Dis book get kweshons about Jesus like: Who pipol dey tok sey Jesus bi? So, afta Jesus don do plenty mirakles, en disciple kon really know sey Jesus, true-true, na God Son.

Àwon tá yàn lọ́wọ́lọ́wọ́ báyìí:

Mark Introdushon: pcm

Ìsàmì-sí

Pín

Daako

None

Ṣé o fẹ́ fi àwọn ohun pàtàkì pamọ́ sórí gbogbo àwọn ẹ̀rọ rẹ? Wọlé pẹ̀lú àkántì tuntun tàbí wọlé pẹ̀lú àkántì tí tẹ́lẹ̀