Romans Introdushon

Introdushon
Na Apostle Paul rite dis leta to di bilivers wey dey Rome. Paul rite di leta to tish di Christians for Rome about di law and how pipol go kon save wen dem bilive sey na God grace bi di ansa for man sin. E esplain sey Jew pipol law nor fit defeat deat or give life, but God plan to save both Jew and Gentile pipol thru Jesus deat and resureshon. Di main lesin bi sey God dey kreate one new family and wen dem baptize pesin inside Jesus, e go get to ovakom evil pawa and freedom go bi di pesin own, as di Holy Spirit go dey lead di way in di new life.

موجودہ انتخاب:

Romans Introdushon: pcm

سرخی

کاپی

موازنہ

شئیر

None

کیا آپ جاہتے ہیں کہ آپ کی سرکیاں آپ کی devices پر محفوظ ہوں؟ Sign up or sign in