1
Romans 6:23
Holy Bible Nigerian Pidgin English
pcm
Bikos, di reward for sin, na deat, but God gift wey Jesus Christ dey give us, na life wey nor dey end.
Konpare
Eksplore Romans 6:23
2
Romans 6:14
Sin nor go fit kontrol una, bikos una nor dey under di law again, but na God grace dey kontrol una naw.
Eksplore Romans 6:14
3
Romans 6:4
Dem beri us with am wen wi baptize, so as God raiz Christ from deat thru en pawa with glory, na so wi too go get life wey nor dey end.
Eksplore Romans 6:4
4
Romans 6:13
Make una nor let Satan use una body take do bad tins, but make una karry unasef give God as pipol wey don wake-up from deat, so dat una go dey do good tins.
Eksplore Romans 6:13
5
Romans 6:6
Wi know sey di pesin wey wi bi before, dem don nail am for cross with Jesus. So awa body nor bi sin savant again.
Eksplore Romans 6:6
6
Romans 6:11
So make una know sey, una don ovakom sin too and una get life thru Jesus Christ.
Eksplore Romans 6:11
7
Romans 6:1-2
So wetin wi go tok? Make wi kontinue to dey sin so dat God grace go dey with us? No! Why wi wey don turn from sin go still dey live inside am?
Eksplore Romans 6:1-2
8
Romans 6:16
Yu nor know sey wetin yu give yor body to, na-im go kontrol yu? If na sin, e go kause deat, but if na God, E go make yu dey live raitious life.
Eksplore Romans 6:16
9
Romans 6:17-18
But wi tank God sey, even doh una bi slave to sin before, una don use una heart dey obey all di tins wey wi dey tish una. And as e bi sey una don free from sin, una don bikom slave to good tins.
Eksplore Romans 6:17-18