Jenesis 2

2
God Kreate Man And Woman
1God kon kreate evritin wey dey di heaven and di eart finish.
2For di sevent day, God finish di work wey E dey do and E kon rest. 3God bless di sevent day kon make am holy, bikos na dat day E stop all di work wey E dey do since.
4Dis na di story about di heaven and eart wey God kreate. 5For dis time, nor-tin don ever grow for di eart, bikos Oga God neva let rain fall and nobody dey wey go klear di groun or plant put. 6But wota dey flow from di sea kon wet di groun. 7So Oga God take some san-san for groun take mold man kon breath life enter en nose, den di man kon dey breath.
Eden Gardin
8God make Eden Gardin for di east kon put di man wey E kreate for der. 9God kon make difren trees make dem grow for di soil and dem dey good for food. (Naw, di tree wey get life, wey dey make pesin know tins well-well; wey dey good and bad, dey for di gardin centre.)
10So as wota dey flow from Eden go wota di gardin, e dey from der, divide into four river. 11Di first river name na Pishon; e dey flow for Havilah land, di place where gold dey. 12(Di gold wey dey di land, dey pure and difren-difren good iron still dey der too.) 13Di sekond river name na Gihon; e dey flow pass Kush land. 14Di third river name na Tigris; e dey flow pass di east for Assyria. And di fourt one name, na Eufrates.
15God take man kon put am for Eden Gardin, so dat e go kare for evritin. 16Den Oga God kommand di man sey, “Yu fit chop from evry tree wey dey di gardin, 17but make yu nor chop from di tree wey get life; wey dey make pesin know tins; di tree wey dey good and bad, bikos wen ever yu chop from am, na dat day, yu go die.”
18Den God kon sey, “E nor good make only man dey. I go gi-am somebody wey go make belle sweet am.” 19God make evritin wey get life from di groun. E bring dem kom meet di man make e give dem name and any name wey di man koll any animal, na dat name go follow am. 20So man name all di animals, birds for di sky and evritin wey get life for di eart, but Adam nor si anytin wey bi like am. 21So Oga God kon make man sleep deep sleep and as e dey sleep, God take one from di man rib kon use flesh kover di place. 22Den Oga God make anoda pesin from di rib wey E take from di man, den E bring am kom meet di man.
23Den di man sey,
“At last, dis one bone kom from my bone
and en flesh kom from my flesh;
I go koll am, ‘Woman,’
bikos God make am from man.”
24Dat na di rizin why man must live en papa and mama kon go stay with en wife and dem two go bikom one.
25Di man and en wife nor wear anytin for body, but shame nor katch dem at-all.

वर्तमान में चयनित:

Jenesis 2: pcm

हाइलाइट

शेयर

कॉपी

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in

YouVersion आपके अनुभव को वैयक्तिकृत करने के लिए कुकीज़ का उपयोग करता है। हमारी वेबसाइट का उपयोग करके, आप हमारी गोपनीयता नीति में वर्णित कुकीज़ के हमारे उपयोग को स्वीकार करते हैं।