Levitikus 9
9
Woship For Di Tabanako
1For di eight day, Moses koll Aaron and en sons and di leaders for Israel kon 2tell Aaron, “Make yu take one yong melu and one ram wey dey okay kon give dem to God. Di melu go bi for sin ofrin, while di ram na for burnt ofrin. 3Den yu go tell Israel pipol sey, ‘Make dem take one goat for sin ofrin, one melu and one lamb wey bi one year wey dey okay kon use dem as burnt ofrin, 4den dem go take one melu and ram for peace ofrin. Dem go sakrifice dem give God with di korn ofrin wey dem mix with olive oil. Dem must do am, bikos God go appear to dem today.’ ”
5So dem take evritin wey Moses kommand go di tent front and di whole kommunity gada for der kon woship God. 6Den Moses tell dem, “Dis na wetin God kommand una to do, so dat di lite wey dey shine for en present, go appear to una.”
7Den Moses tell Aaron, “Make yu go di altar go offa di sin ofrin and di burnt ofrin, so dat God go forgive una and di pipol. Make yu do di ofrin for di pipol, so dat God go forgive una just as E don kommand.”
Sin Ofrin For Di Priests
8Aaron go di altar kon kill di yong melu for en own sin ofrin. 9En sons karry di blood gi-am, den e shuk en finger put kon put am for di horn wey dey di altar and e pour di remainin ones under di altar. 10E burn di fat for di altar, di two kidney and dia fat and di best part for di liver, just as God kommand Moses. 11But e burn di meat and di skin for outside di kamp.
Burnt Ofrin For Di Priests
12E kill di animal wey dem won use for burnt ofrin. En sons karry di blood gi-am and e rub am for di four side for di altar. 13Dem give Aaron di head and di oda pieces for di animal and e burn dem for di altar. 14E wosh di intestine and di leg kon burn dem for di altar on-top di remainin burnt ofrin.
Ofrin For Di Pipol
15Afta, e kon do ofrin for di pipol. E take di goat wey dem give for di pipol sin kon kill-am and e first do en own sin ofrin. 16E still bring di animal for di burnt ofrin kon gi-am akordin to di law. 17E give di korn ofrin; pak flower full en hand kon burn am for di altar. (Dem go dey add dis one join di burnt ofrin evriday.)
18E kill di melu and di ram as peace ofrin for di pipol. En sons karry di blood gi-am and e rub am for di four side for di altar. 19Aaron put di melu fat and di ram 20on-top di animal breast kon karry all go di altar. E burn di fat for di altar 21kon give di breast and di rite leg as special gift to God for di priests, just as Moses kommand.
22So, Aaron bless di pipol wen e don finish all di sakrifice. 23Moses and Aaron enter di tent and wen dem kom out, dem kon bless di pipol, den di lite wey dey shine for God present kon appear to di pipol. 24At wons, God send fire go burn di burnt ofrin and di fat dem for di altar. Wen di pipol si am, dem kon shaut and bow face groun.
Iliyochaguliwa sasa
Levitikus 9: pcm
Kuonyesha
Shirikisha
Nakili
Je, ungependa vivutio vyako vihifadhiwe kwenye vifaa vyako vyote? Jisajili au ingia
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee