Levitikus 15
15
Wen Man Discharge
1Den God tell Moses and Aaron: 2“Make una go tell Israel pipol sey, ‘Wen man discharge, e go dey unklean, bikos of dat tin. 3Weda di tin dey komot from en body or e don stop, di man don dey unklean. 4Any bed wey e liedan or sidan put, don dey unklean.
5“ ‘Anybody wey tosh di bed wey di man liedan put must go wosh en klot kon baf with wota and di pesin go dey unklean till evening. 6Anybody wey sidan for di chair wey di pesin wey discharge sidan put before, must wosh en klot, baf with wota and e go dey unklean till evening. 7Anybody wey tosh am must go wosh en klot, baf and e go dey unklean till evening. 8If di pesin wey discharge, spit for pesin wey dey klean body, dat pesin must go wosh en klot kon baf, but e go dey unklean till evening. 9Anytin wey dem dey ride or chair wey di pesin sidan put go dey unklean. 10Anybody wey tosh wetin e sidan put go dey unklean till evening. Anybody wey karry wetin di pesin sidan put must go wosh en klot, baf, but e go still dey unklean till evening. 11Anybody wey tosh di man wey discharge and e nor wosh en hand, must go wosh en klot and baf with wota, but e go still dey unklean till evening. 12If di man tosh klay pot, dem must break am and if na plate wey dem make with wood naim di man tosh, dem must wosh am.
13“ ‘Wen di man wey discharge don klean, e go wait for seven days, wosh en klot kon baf with fresh wota and e go dey klean. 14For di eight day, e go take two dove or two pijin kom di tent gate for God present kon give dem to di priest. 15Di priest go offa one for sin ofrin and di oda one for burnt ofrin. Na like dis di priest go take make sakrifice for di man for God eye.
16“ ‘Wen di man discharge, e must go baf, but e go dey unklean till evening. 17Anytin wey dem do with klot or leda and di discharge tosh am, dem must wosh am and di tin go dey unklean till evening. 18Afta di man don sleep with di woman finish, di man and di woman must go baf and dem go dey unklean till evening.
Wen Woman Mestrate
19“ ‘Wen woman dey mestrate, e go dey unklean for seven days. Anybody wey tosh am go dey unklean till evening. 20Anytin wey e sidan or liedan put wen e dey mestrate, go dey unklean. 21Anybody wey tosh di bed wey e sleep put must wosh en hand kon baf, but e go dey unklean till evening. 22Anybody wey tosh di chair wey e sidan put must go wosh e klot, baf with wota and e go dey unklean till evening. 23If anytin dey for di bed or di chair wey e sidan put, wen e tosh am e go dey unklean till evening. 24If man sleep with am for dat time, e go dey unklean for seven days and any bed wey di man sleep put, go dey unklean too.
25“ ‘Wen di woman dey mestrate before di rite time or if di blood still dey flow wen e suppose don stop, e go dey unklean as far as di blood still dey flow. 26Any bed wey e sleep or anytin wey e sidan put, go dey unklean for dat time. 27Anybody wey tosh dem, dey unklean and e must go wosh en hand kon baf, but e go dey unklean till evening.
To Santify Woman Wey Nor Klean
28“ ‘Wen di blood don stop, di woman go wait for seven days, den e go dey klean. 29For di eight day, e go take two dove and two pijin go give di priest for di tent gate for God present. 30Di priest go offa one for sin ofrin and di oda one for burnt ofrin, na like dis di priest go take make sakrifice before God.’ ”
Konklusion
31God tell Moses make e warn Israel pipol about dia dirty life, so dat dem nor go spoil God house wey dey di kamp centre. If dem do am, dem go die. 32“Dis law na for men wey dey discharge, 33woman wey dey mestrate or man wey sleep with woman wey nor klean.”
Iliyochaguliwa sasa
Levitikus 15: pcm
Kuonyesha
Shirikisha
Nakili
Je, ungependa vivutio vyako vihifadhiwe kwenye vifaa vyako vyote? Jisajili au ingia
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

: