Di wimen wey dey play di music kon dey sing sey,
“Saul kill 1,000,
but David don kill tazon times tazon pipol.”
Dis tin kon make Saul dey vex. E nor like di word wey di wimen dey tok and e kon tink for en mind sey, “Dem dey sey David don kill tazon times tazon pipol, but mi, only 1,000. Wetin e nor get escept di kingdom?”