Levitikus 10
10
Nadab And Abihu
1Den Aaron sons, Nadab and Abihu kon take fire pan, put fire and incense inside kon give God anoda ofrin wey E nor kommand dem. 2So fire kom out from God present kon burn dem die.
3Moses tell Aaron, “Dis na wetin God tok:
“ ‘Among di pipol wey dey klose to mi,
I go show mysef holy to dem
and for where evribody dey,
na der dem go for honor mi.’ ”
So Aaron nor tok anytin.
4Den Moses koll Mishael and Elzafan wey bi Aaron papa broda Uzziel pikin kon tell dem, “Make una kom karry una brodas body komot from di sanctuary go beri outside di kamp.” 5So dem karry dem komot with dia tunik go outside di kamp, just as Moses tok.
6Den Moses tell Aaron and en two oda sons, Eleazar and Itama sey, “Make una nor barb una hair or tear una klot to show sey una dey mourn. If una do am, una go die and God go vex for di kommunity. But Israel pipol fit mourn, bikos God kill Nadab and Abihu. 7But una nor go komot from di tent gate or una go die, bikos di anointin oil don make una dey holy for God present.” So dem kon do wetin Moses tell dem.
God Tok To Aaron
8Den God tell Aaron, 9“Make yu and yor sons nor drink wine or strong drink wen una enter di tent, so dat una nor go die and dis na law wey yu and yor shidren-shidren must obey. 10Yu go separate wetin bi God own from human being own; wetin holy from wetin nor dey holy. 11Yu must tish di pipol all di laws wey I don give yu thru Moses.”
Moses Tok To Aaron
12Moses kon tell Aaron and en two sons Eleazar and Itama sey, “Make una use di korn ofrin wey remain from di food wey dem offa give God, take make bread wey nor get yist, den chop am for di altar side, bikos na holy ofrin. 13Make una chop am for di Holy Place, bikos dat na yu and yor sons own. Dis na wetin God kommand. 14Yu and yor family go fit chop di breast and di leg wey dem give as special gift and di special kontribushon wey dem give God. Yu go fit chop am for any place wey dey holy. Na yu and yor sons get dis ofrin, bikos na part of di peace ofrin wey Israel pipol give. 15Dem go bring di leg and di breast wen dem won give as food ofrin to God. Dis part na yu and yor shidren own forever, just as God don kommand.”
Di First Sin Ofrin
16Moses ask for di goat wey dem take do sin ofrin, but dem tell am sey dem don already burn am. E vex for Eleazar and Itama kon ask, 17“Why una nor chop di sin ofrin for where dey holy? Na bikos e dey holy well-well naim make God give una make E for forgive di kommunity dia sins. 18Since dem nor bring di animal blood kom di holy tent, den una for chop di sakrifice for der, just as I kommand!”
19Aaron ansa, “If I chop di sin ofrin today, God go happy with mi? Bikos even doh di pipol give God dia sin and burnt ofrin today, all dis bad tins still dey happen to mi.” 20Wen Moses hear dis tin, e nor kon vex again.
Currently Selected:
Levitikus 10: pcm
Highlight
Share
Copy
Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee