Ekklesiastes Introdushon
Introdushon
Ekklesiastes na about difren words wey di “Tishas” or “Prishas” rite. Di book diskribe di Tisha as pesin wey don bi Israel king for Jerusalem before and wey bi David pikin. Dis two tins show sey di pesin na from royal family and na Solomon. Di sayin, “Evritin dey yuzles! Yes, evritin really dey yuzles” wey dem repeat many times, dey warn us sey nor-tin really dey last or fit satisfy us for dis life. Di book make us si some important tins and ask kweshons about life. Like wen di tisha sey wetin don bend nor go dey strait again, e dey remind us sey e hard to ripair wetin don spoil. So to make tins rite and to do good tins again, naim bi di big lesin for di book. Aldo, di tisha nor tell us about wetin God dey do to save di world, all wetin e dey tok about na sey God dey mighty and naim bi Oga ova evritin and na awa duty to follow di korrect way just as God tok am, bikos God go judge evribody afta dem live dia life.
Currently Selected:
Ekklesiastes Introdushon: pcm
Highlight
Share
Copy
Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

: