Ekklesiastes 1
1
Life Dey Yuzles
1Na King David pikin, Solomon, wey dey rule Jerusalem, rite dis words.
Evritin Dey Yuzles
2Di tisha sey, “Evritin dey yuzles!
Yes, evritin really dey yuzles!”
3Wetin pipol dey gain from all di hard work
wey dem dey do for dis world?
4Wen one generashon kom, di one wey dey before go-go,
but di world nor dey shange.
5Di sun dey raiz-up and down,
den e go hurry go anoda place where e go for raiz again.
6Breeze dey blow go sout and nort.
Yes! E dey blow round like circol.
7Even as wota dey flow enter sea rish,
di sea nor dey ever full,
bikos, na from where di wota from kom,
na der dem go rush go again.
8All dis tins dey taya pesin and nobody fit shange or tok as dem bi:
No matter wetin wi dey si and hear,
awa eyes still won si and awa ear still won hear more.
9Wetin don happen before, go happen again
and wetin pipol don do before,
dem go do am again,
bikos nor-tin dey new for dis world.
10E get anytin for dis world wey fit make pesin sey,
“Kom si o-o! Dis one neva happen before o-o”?
But di trut bi sey, e don happen even
before dem born us.
11Wi nor dey remember wetin don happen before and for di next generashon,
nobody go remember wetin wi dey do naw.
12Mi wey dey tish una, I bi king for Israel and I stay for Jerusalem 13and I make up my mind to search and undastand evritin wey pipol don do for dis world. But I kon si sey, God don really give us betta work to do for dis world. 14As I tink about evritin wey human being dey do for dis world, I kon sey: Evritin dey yuzles; e just bi like sey pesin dey porshu breeze.
15Wetin bend, wi nor go fit strait am
and wetin nor dey, wi nor go fit provide am.
16Den I tell mysef, “Na mi wise pass evry oda king wey don rule for Jerusalem before mi. Bikos I get wisdom and undastandin wey dem nor get.” 17So I kon gri to find out wetin wisdom, madness and foolishness bi. But e klear sey, na breeze I just dey porshu,
18bikos di more I dey find out,
di more e dey worry mi well-well,
bikos plenty wisdom dey bring plenty wahala too.
So di more yu know,
di more yu dey kause wahala for yorsef.
Currently Selected:
Ekklesiastes 1: pcm
Highlight
Share
Copy
Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

: