Deutronomi 9
9
God Grace
1Israel pipol, make una listin! Today una won cross Jordan River kon go take doz strong pipol wey get pawa pass una, land. Dem dey stay for towns wey di wall rish di sky! 2Di pipol strong well-well and dem tall; dem bi Anak shidren-shidren. Una hear wen dem sey, “Na who go fit fight Anak pipol?” 3But make una undastand today sey, di Oga una God wey dey waka for una front na fire wey dey burn anytin; E go win dem kon make dem bi like mumu for una front. Just as God tell una, na so una go kwik-kwik konker and distroy dem finish. 4Afta di Oga una God don do all dis tins for una, make una nor tok for una heart sey, “God give us dis land bikos wi good well-well!” Nor bi bikos una good make God give una, but na di wikedness wey dis oda pipol dey do, na-im make God porshu dem komot for una. 5Una nor dey enter and stay dis land, bikos una dey good or get sense. Di Oga una God go porshu dis pipol komot for una, bikos of di wikedness wey dem dey do and to fulfil di promise wey E make with una grand-grand papa, Abraham, Isaak and Jakob. 6So make una undastand naw sey nor bi bikos una good make di Oga una God dey give una dis land, bikos una nor good and una bi sturbon pipol.
Israel Sturbon
7Make una remember and nor ever forget how una make di Oga una God vex for di wildaness. From di day wey una komot Egypt kon rish naw, una dey always sin against God. 8Even for Mount Sinai, una make God vex well-well sotey E won kon distroy una. 9Dis tin happen wen I go di mountin go kollect di ten kommandment wey God make for una. I dey der for forty days and forty nite and I nor chop or drink anytin. 10God give mi two stones and all di kommandment wey E tell una from inside di fire wen una gada go meet am for di mountin, E use en own hand take rite dem put for di stones. 11Wen di forty days don finish, God give mi di two stones wey E rite di kovenant put. 12Den God sey, “Make yu get up! Just dey go at wons, bikos di pipol wey yu bring out from Egypt don dey sin. Dem kwik-kwik forget kon komot from di way wey I sey make dem dey live dia life! Dem don melt gold take make juju for demsef!” 13God still sey, “I don si sey dis pipol sturbon well-well! 14So make yu leave mi make I distroy all of dem komot from dis eart. Den I go make strong and mighty pipol from yor shidren-shidren.” 15So I turn komot di mountin as di fire still dey burn and di two kovenant stones dey my hand. 16Wen I rish where una dey, I si sey una don really sin against di Oga una God and una don make juju for unasef; una don kwik-kwik turn komot from di way wey God kommand una! 17So I take di two kovenant stones wey di kommandment dey kon skata dem for una front. 18Den I go stay for God present for anoda forty days and forty nite; I nor chop or drink anytin bikos of all di sins wey una don kommit wen una dey do wiked tins wey go make God vex well-well. 19I dey fear God vexnashon, bikos E sey E go distroy una. But dis time, E still listin to mi again. 20God vex well-well for Aaron and E won kon distroy am too. But I pray for Aaron and God kon sorry for am. 21I take una sin; di juju wey una make kon melt and grind am till e bi like san-san. Den I pour am for wota wey dey flow kom from di mountin. 22And una still make God vex for Taberah, Massah and Kibrot Hattaavah. 23Den wen E send una from Kadesh Barnea kon sey, “Make una go take di land wey I don give una,” una still sin against di Oga una God, bikos una nor bilive or obey am. 24Una don dey sin against di Oga una God rite from di first day wey I know una!
Moses Beg For Dem
25I liedan for groun for God present for forty days and forty nite, bikos E sey E go distroy una. 26I pray to am, “My Oga God, make Yu nor distroy yor pipol wey bi yor betta propaty; pipol wey Yu save with yor own pawa kon take dem komot from Egypt with yor strent. 27Make Yu remember yor savant, Abraham, Isaak and Jakob; den nor look as dis pipol sturbon, wiked and di sins wey dem dey kommit. 28Bikos if Yu distroy dem, Egypt pipol go sey, ‘God nor fit karry dem go rish di land wey E promise dem and bikos God hate dem well-well, E take dem komot here go kill for di wildaness.’ 29Dem bi yor pipol, yor betta propaty wey Yu take komot Egypt with yor great strent and pawa.”
Currently Selected:
Deutronomi 9: pcm
Highlight
Copy
Compare
Share
Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee