YouVersion Logo
Search Icon

Deutronomi 18

18
Priest and Levi
1Make una remember sey Levi pesin wey bi priest, plus di whole Levi tribe nor get any propaty or land among di oda tribes for Israel. Instead di priest and Levi pipol go chop from di special gift wey di oda tribes go give God, bikos na dat bi dia share. 2Dem nor get any land for diasef for Israel. Na God bi dia propaty, just as E don tell dem.
3Di tins wey di priests go take as dia own share, na di animals and oda tins wey di oda tribes bring kom as ofrin: dem go take di animals shoulder, jaw and belle. 4Di first share for una harvest, new wine, olive oil and di wool wey una kollect wen una dey shear di sheep, make una give dem to di priest. 5Bikos na di Oga una God choose Levi tribe out of all di tribes wey dey Israel to serve am forever.
6And if one Levi pesin kom from any town for Israel kon sey e dey go where God don choose sey make dem woship am, 7e fit serve for der with God name, just like evry oda Levi wey bi priest wey dey serve God for der. 8Dem go give di same food like di oda priests and e fit keep anytin wey en family send kom gi-am.
Profet
9Wen una enter di land wey di Oga una God dey give una, make una nor learn wetin di oda kountries for der dey do. 10For ezample, make una nor burn una shidren as sakrifice. And make nobody learn how to dey tell pipol dia future; 11learn to use juju; how to tok to oda spirit or witch spirit. 12Anybody wey dey do dis kind tin, dey make God vex. Na bikos of dis tins wey di oda kountries do, na-im make God porshu dem komot from di land for una. 13But make una serve di Oga una God well-well, so dat E nor go si any fault for una body.
14Di pipol wey una won porshu dey do dis tins, but di Oga una God dey sey make una nor do dis kind tin. 15Di Oga una God go raiz profet like mi from among una and e go bi una own kountry man and make una listin to am. 16Bikos dis na wetin una ask di Oga una God by unasef wen una gada go meet am for Mount Sinai. Una sey, “God, make Yu nor let us hear yor vois again or si di big fire again, bikos wi go die.” 17God kon tell mi, “Wetin dem tok dey good. 18From among dia own pipol, I go raiz one profet like yu. I go put my word for en mout and e go tell dem anytin wey I kommand. 19Anybody wey nor gri listin to wetin di profet tok, na mi go ponish am with my own hand. 20But any profet wey tok wetin I nor send am or tok about any oda god, go die.
21“But una fit ask unasef, ‘How wi won take know sey, dat message nor bi from God?’ 22Wen any profet dey tok with God name and wetin e tok nor kon happen at-all, una go know sey nor bi God send am, but di profet just dey tok on en own, so make una nor listin, bilive or fear am.”

Currently Selected:

Deutronomi 18: pcm

Highlight

Copy

Compare

Share

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in