YouVersion Logo
Search Icon

Deutronomi 11

11
God Great
1Una must love di Oga wey bi una God kon obey evritin wey E tok. Dat is, en law, rules and kommand wey E give una. 2Make una know for una mind sey, I nor dey tok to una shidren wey neva si as di Oga una God judgement bi or si as E big and strong rish. 3Dem nor si all di wonderful signs wey E do for una wen una dey serve King Fero and en pipol for Egypt. 4Dem nor si wetin God do to Egypt sojas and dia shariot. How E take kill dem for di Red Sea wen dem dey porshu una. E distroy dem finish and dem neva fit balance kon rish today! 5Una shidren nor si wetin God do for una wen una dey di wildaness before una rish here. 6Dem nor si wetin E do to Datan and Abiram (wey Eliab wey kom from Reuben tribe, bi dia papa) wen groun open for Israel kamp kon swallow dem with dia family, dia house and evritin wey dem get. 7But I dey tok to una bikos na una si all di wonderful tins wey God do!
Promise Land
8Naw, make una listin to all en kommand wey I dey give una today, so dat una go strong rish to kollect and enter di land wey una dey go so. 9If una obey di kommand, una go get long life for di land wey God promise sey, E go give una grand-grand papa and una wey bi dia shidren; land wey milk and honey full! 10Bikos di land wey una go soon enter go stay, nor bi like Egypt where una from dey kom and where una nid to work with una hand and leg to take plant vegitabol. 11But di land wey go soon bi una own, na land wey get hills and valleys with plenty rain, 12di kind land wey di Oga una God like well-well. From one year to anoda, God dey wosh ova di land!
13Naw, if una listin well-well to my kommand, wey I dey tell una today kon love di Oga una God and serve am with all una heart and mind, 14E go send rain for una land for di rite time, both di early and late rain, so dat una go harvest una food, new wine and oil. 15E go give una animals plenty grass for di land and una go chop beleful.
To Obey Di Law
16But make una dey kareful. Make una nor let anybody deceive una, so dat una nor go turn from God kon dey serve and woship oda gods. 17If una do like dis, God go vex for una well-well. E go lock di sky and rain nor go fall, den di groun nor go bear food. Den una go kwik-kwik die for di good land wey God dey give una. 18So make una keep dis kommand for una mind. Make una tie dem for una hand kon wear dem for una head, so dat una go remember dem. 19Make una tish dis kommand to una shidren. Make una tok about dem wen una dey house and wen una dey for road, even wen una won sleep and wen una wake-up. 20Make una rite dem put for una door-mot and for una gate, 21so dat as long as di sky dey on-top di eart, una and una shidren go dey betta for di land wey God promise una grand-grand papa.
22Make una dey kareful as una dey obey all di kommand wey I dey give una today. Make una show love to di Oga una God kon bilive and do as E sey make una do. 23Den God go drive all di kountries wey dey una front, aldo dem really strong and great pass una, but una go take dia land. 24Anywhere wey una waka rish, dat land go bi una own. Una land go long and wide from di wildaness go Lebanon and from River Eufrates go rish Mediterranean Sea. 25Nobody go fit stop una; di Oga una God go make dem fear una for any land wey una waka enter, just as E promise una.
Di Blessing And Di Curse
26Si, today I dey give una shance to pick between blessing and curse! 27God go bless una if una obey di Oga una God kommand wey I dey give una today. 28But na curse bi una own, if una rijet di Oga una God kommand kon turn from am go woship oda gods wey una nor know before. 29Wen di Oga una God take una enter di land kon help una stay der, una must tok about di blessing for Mount Gerizim and di curse for Mount Ebal. 30(Dis two mountins dey di west side for Jordan River where Kanaan pipol for di Valley, dey stay, near Gilgal town wey nor far from Moreh Oak.) 31Bikos una go soon cross Jordan River go take di land wey God dey give una. Wen una take di land kon dey stay inside, 32make una dey kareful as una dey obey all di rules and law wey I dey give and tell una today.

Currently Selected:

Deutronomi 11: pcm

Highlight

Copy

Compare

Share

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in