1
Ekklesiastes 3:1
Holy Bible Nigerian Pidgin English
pcm
Evritin wey dey happen for dis world, dey happen for di rite time wey God wont make e happen.
Compare
Explore Ekklesiastes 3:1
2
Ekklesiastes 3:2-3
Time dey to born and time dey to die; time dey to plant sometin and time dey to harvest wetin yu plant. Time dey to kill and time dey to heal pesin; time dey to skata and time dey to build.
Explore Ekklesiastes 3:2-3
3
Ekklesiastes 3:4-5
Time dey to kry and time dey to laf; time dey to mourn and time dey to dance. Time dey to skata stones and time dey to gada dem again; time dey to embrace pesin and time dey not to embrace pesin.
Explore Ekklesiastes 3:4-5
4
Ekklesiastes 3:7-8
Time dey to tear klot and time dey to sew; time dey to just dey kwayet and time dey to tok. Time dey to love pesin and time dey to hate pesin too; time dey to fight war and time dey to make peace.
Explore Ekklesiastes 3:7-8
5
Ekklesiastes 3:6
Time dey to find sometin and time dey to stop to find; time dey to keep sometin and time dey to trowey tins.
Explore Ekklesiastes 3:6
6
Ekklesiastes 3:14
Bikos I know sey anytin wey God do, na final and e go dey forever; dem nor go fit add anytin join am or remove anytin from inside. God make evritin like dis, so dat pipol go fear am.
Explore Ekklesiastes 3:14
7
Ekklesiastes 3:17
Den I tell mysef, “E nor go tey before God go judge evribody, bikos of evritin wey dem don do! Both good and bad pipol.”
Explore Ekklesiastes 3:17
Home
Bible
Plans
Videos