Naw, if una listin well-well to my kommand, wey I dey tell una today kon love di Oga una God and serve am with all una heart and mind, E go send rain for una land for di rite time, both di early and late rain, so dat una go harvest una food, new wine and oil.