Naw, Israel pipol, wetin di Oga una God wont from unasef? E wont make una dey fear am kon dey live di kind life wey E wont make una live. E wont make una love, respet and serve am with all una soul and heart. Una must always obey God kommand and law wey I dey give una today, so dat evritin go dey well with una.